2018 video wey Obasanjo quarrel Buhari comot again as Tinubu criticism


On Wednesday, one video wey former President Olusegun Obasanjo dey describe di federal government as “ineffective and incompetent”, and make Nigerians no accept failure, don appear for social media.

Some of di social media users wey post di video claim sey Obasanjo bin dey criticise di administration of President Bola Tinubu.

Tunde Ednut, one Nigerian celebrity blogger, post one version of di video for im Instagram handle wey get over five million followers. (archived here).

For di version of di video wey Ednut post, dem join Tinubu foto for background.

Di Instagram post, wey im write “Hmmmmmmmmmmmm!!!!” don gada pass 2,000 reposts, 29,000 likes, 2,800 comments, and 1,700 shares.

Anoda version of di video wey dem post for X get direct reference to Tinubu.

One X user, @ejykmykel1, post di video come write: “H.E Olusegun Aremu Obasanjo. You tok well 👏 APC no go like dis one”.

Di X post don gada pass 2,900 reposts, 160 quotes, 4,900 likes, and 855 bookmarks.

Anoda X user, @ukocarter, also post di same video write: “”Tinubu don fail, im incompetence don kill plenti businesses. No allow am come back for 2nd term” — OBJ”.

WETIN WE CHECK

For di viral video, Obasanjo no mention Tinubu name.

Google image search of di key frames from di viral video show sey di video don dey online since April 2018.

Dem post di video here, here, and here for 2018.

Credible media platforms like TheCable, Channels Television, and Punch bin report wetin Obasanjo tok on April 2, 2018.

Dem record di video when members of diNew Nigeria group visit Obasanjo for di Olusegun Obasanjo Presidential Library for Abeokuta, di Ogun state capital.

Di former president criticise di administration of late former President Muhammadu Buhari sake of how di economy bin dey as of April 2018.

Obasanjo tok sey Nigerians suffer di incompetence of Buhari administration.

Buhari na president of Nigeria from 2015 to 2023.

Before di April 2018 comment, Obasanjo, write open letter give Buhari for January 2018 sey make im forget about di 2019 election sake of im performance for office.

Obasanjo no gree make Buhari continue for office as di 2019 presidential election bin dey near.

FINAL TOK

Di viral video wey Obasanjo dey criticise di federal govment sake of di economy na from April 2018, no be during Tinubu administration.





Source link

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*